Optimism Dey Provide one Shared Resource For DAOs

DAOs Wey Wan Shape di Future fi Reason di Past for Inspiration.

Translation by ScAr | Artikul by trewkat | Edited by Kornekt


As global communities wey dey scattered all over di world, DAOs no get option but to rely on digital record-keeping. You fit talk say, "Na true," say na why DAOs dey vote onchain. You no lie sha, but even tho di 'A' for DAO stand for 'autonomous,' wey mean say decisions wey dem dey make from votes dey apun automatically thru smart contracts, di reality no dey like dat for many DAOs.

Even if all di votes dey recorded thru blockchain (and dem dey manage all di actions thru smart contracts), we no fi forget di fact say plenti talk and debate dey apun well well before di vote. Dis important part of shared decision-making dey normally apun for online forum wey dey offchain, e mean say if you check one DAO's Snapshot, e no go show di complete story of how dem take dey govern.

Na why di work wey di Optimism Collective dey do to create and share "Di Collective DAO Archives: Governance Library" na sumtin wey get value. Dis work no just gada di governance journey of 20 important DAOs put one place, e still make am possible to bring all di information togeda and carry ten important points comot.

I don talk about dis "goldmine" for one artikul before, wey dey talk about di way wey di Optimism Collective dey take approach governance. Shout out to Justine Humenansky wey complete di research and lessons for di Optimism Foundation, if you look am, you go see aw easy e dey to see aw dem dey apply di things wey dem learn thru di Optimism Collective's continuous reflekshun and di way dem take get two voting groups wey get dia separate concerns but still dey share concerns.

Di amazing part be say because di Optimism Collective dey focus on public goods, di Collective DAO Archives dey open for evribodi to access (dem just gats give respekt), and dem dey always update am. E mean say di whole community fi share from di wisdom of 20 DAO lifetimes.

Reflekt di Knowledge

You fi see as Justine as she dey present her findings for dis video wey dem take for ETHDenver 2023, you fi also see di slides wey she use for di presentation, or read di full X thread for di highlights.

One of di slides from di Collective DAO Archives presentation for ETHDenver
One of di slides from di Collective DAO Archives presentation for ETHDenver

Di ten important points wey Justine gada na from her reading of thousands of forum posts. Togeda, dem to create one checklist wey you must read if you wan learn how to DAO wella. I don summarize dem from di X thread for dis artikul, but I go advise you make you go check am yourself.

Takeaway #1: Voting

Make sure di way you dey make decisions – how much decentralization and delegation you use – match di type of decision wey you wan make.

Takeaway #2: Strategy

Create and use frameworks wey go help you set priorities early so your decisions fi follow one strategy, even as you dey give more power to di community.

Takeaway #3: Treasury

Create funding structures wey dey flexible and wey get goals.

Takeaway #4: Accountability

Di best way to reward proposals and ideas na when dem don do am. Make sure say di DAO dey run like one "do-ocracy" so that e go encourage competition, speed, and experimentation.

Takeaway #5: Organizational

Define aw power dey work for your organization instead of ignoring am. Dis one na di way to control am well. [You fit read dis bonus artikul about dis topic].

Takeaway #6: Contributors

Know di difference between di pipu wey dey elected to represent and di pipu wey volunteer to contribute. Set up structures for accountability and compensation base on dat level.

Takeaway #7: Path to decentralization

If you wan gradually dey give more power to di community, make sure say you make am clear about aw control dey work and how e go dey change.

Takeaway #8: Policy

Make sure say your governance dey flexible so dat e fi respond and adapt well instead of just reacting.

Takeaway #9: Tooling

Communication wey go make evribodi wey dey contribute fi give feedback and access feedback, gats be priority.

Takeaway #10: Concerns

Conflict go apun at some point, but e no mean say di DAO go fail. Di important thing na legitimacy, go determine weda di DAO go succeed or not.

Make we use di Past take Make di Future Bright

Di research findings wey di Optimism Collective share dey very useful, but di best part be say di data wey dem use, dem don arrange and organize am for way wey everybody fi access am. Dis one na top-level research practice, and e dey increase di potential impact of di Archive.

Pipu wey visit di Collective DAO Archives site (wey dey for Notion) fi search by category, DAO, or even proposal title, so dat dem fi find links to di original documents. Even tho di Notion search no dey work, if you wan find sumtin, you fi use Ctrl/Cmd F to search any particular term or DAO wey you dey find.

Pipu wey dey interested for di timeline of how one particular DAO take dey govern fi access am thru di Governance Timeline. Dis timeline go show all di proposals wey dey inside di Notion database, and dem arrange am month by month. Di good news be say dis resource no be just one old snapshot of DAO history – di Optimism Foundation still dey maintain am well.

Di Collective DAO Archives: Screenshot of di Optimism Governance Timeline
Di Collective DAO Archives: Screenshot of di Optimism Governance Timeline

Shared History, Shared Vision

Di way wey dem take mix targeted discovery and serendipity when you dey browse create one important — some pipu go even talk say e dey very necessary — historical record wey fi help different types and sizes of DAOs as dem dey pursue excellence for decentralization.

STUDY DI PAST IF YOU GO DEFINE DI FUTURE.  —  CONFUCIUS

Di way wey di Optimism Collective take share dia vision, wey talk say "togeda, we go create di future of coordinated, collaborative cyberspace," e don dey turn reality small small, thru di Collective DAO Archives.

Subscribe to Pidgin Parlour Crypto Hub
Receive the latest updates directly to your inbox.
Mint this entry as an NFT to add it to your collection.
Verification
This entry has been permanently stored onchain and signed by its creator.